Post Reply 
 
Thread Rating:
  • 0 Votes - 0 Average
  • 1
  • 2
  • 3
  • 4
  • 5
Poem: Wetin (Dave Chukwuji)
08-18-2009, 08:49 AM (This post was last modified: 08-18-2009 08:59 AM by baba.)
Post: #1
Poem: Wetin (Dave Chukwuji)
Why you dey look me
Like goat wey see room and palor
If anything dey ya mind
Make you dry am
Like cloth wey wet
For outside make everybody see.

Wetin
You don forget say
Dem talk say action
Dey shout pass
Women wey dem misplace
Im pickin for maternity ward.

Wetin be ya own
Na me bi di first
Aristo wey stumble
For pikin wey still dey write jam?
Abegi, if di pikin na ya pikin nko
Abi ya wife bi anoda person pikin...

Kotesy: 234next.com 16 Aug 2009, pg. 46 (TLR)
Quote this message in a reply
Post Reply 


Forum Jump:

Contact UsNigerian PijjinReturn to TopReturn to ContentLite (Archive) ModeRSS Syndication