Post Reply 
 
Thread Rating:
  • 0 Votes - 0 Average
  • 1
  • 2
  • 3
  • 4
  • 5
Poem: Dis house no fit fall (Onyeka Nwelue)
08-14-2009, 02:05 AM
Post: #1
Poem: Dis house no fit fall (Onyeka Nwelue)
You tink say dis house fit fall?
Because me I no tink say e fit fall
When everyting wey around am dey strong
So e no fit fall at all at all

I never see dis kin' house before
Because I dey live for inside wetin
Dem dey call Heart of Darkness
Where only de Survivor dey Survive

Now, my heart don dey pain me well well
Because de house wey me I dey stay
Don fall; fall like Satan from Heaven
So as e don fall, so my life don scatter

I know wan make una pity for me
Because dis life dey greedy
Na only promise promise people dey make
But dem no fit fulfil am

I dey tell you dis, because I don see
Dis world tire. Dis world no dey easy
You fit live de way you wan leave
Everyting just dey go up and down

Abeg, make una answer me
If de hut wey my Papa build for village
Fit stand like dis one dey stand like so
Abeg...abeg...make una tell me.

© Onyeka Nwelue 2006

Sos: http://onyekanwelue.blogspot.com/2006/04...o-fit.html
Find all posts by this user
Quote this message in a reply
12-27-2011, 03:38 AM
Post: #2
unspecific
casino casino online casino cassinos casinos online free pokies
Visit this user's website Find all posts by this user
Quote this message in a reply
Post Reply 


Forum Jump:

Contact UsNigerian PijjinReturn to TopReturn to ContentLite (Archive) ModeRSS Syndication