Ma Pipul a de trowee salut fo una,
A laik Naijiria Pijin Lanwej (NPL) wel wel sotee ol di wok wee a de wok fo ma laif na abaut NPL.
Masef, togeda wit di pipul wee a de wok wit dem don rait Baibul fo Naijiria Pijin Lanwej. I no go tee na im di Niu Testament of di Baibul go komot.
Di won wee dee graund nau wee go go fo printin na buk wee im nem na MEK WI SPIIK NAIJIRIA PIJIN. Dis buk dee 2 an tuu of dem na fo tek tich pipul hau to rait an rid fo Naijiria Pijin. Wetin wi de tok bi see, i no gud to de rait Naijiria Pijin enihau enihau. Dis na bikos NPL get im oon ee-bii-sii-di. Di wee fo tek rait im wod-dem no bi di sem wit Oyibo lanwej. An di wee fo tek kol NPL wod-dem no bi di sem wit Oyibo lanwej tuu.
If wi no giv NPL di respekt wee bi im onn, pipul go de yab di lanwej an tek am de mek yeeyee an de kol am yeeyee lanwej. Bot na korekt lanwej wee pipul wee pas won milion pipul de spiik am fo Naijiria.
Di wee wee a de rait NP nau as yu de sii am so bi di korekt wee. Bot i no tuu dee korekt bikos i get som "o" wee sopoz get dot onda am. An i get som "e" wee sopoz get dot onda am. Sodiafo if fo ezampul dot dee onda "o" yu go kol di wod laik as yu go kol "Bot" wee bi Bo.t ("But" fo Oyibo). Dat "o." sopoz get di dot onda di "o". If yu no put di dot fo onda di "o" den di "Bot" go saund laik "Bot" wee bi di "bot" dem de tek travul fo wota.
Nau, ma broda-dem an sista-dem wee de oganaiz dis forum, mek wi faind wee fo mek NPL folo korekt wee fo tek rait am an mek wi sii hau wi fit tek put di dot-dem wia wi sopoz put dem as wi de rait tins fo dis forum. Mi a redi fo bi ticha fo NPL fo dis forum.
If yu want no moo tins abaut NPL mek yu rait mi tru di pipul wee de oganaiz dis forum. Dem get ma i-mel adres oo mek yu fon mi fo 08034358564.
Na una broda de rait so,
Dumama
Naijiria Pijin Baibul Transleto
Dumama! Dumama!! Dumama!!! how many tims I col you? O boy (abi na O gel?), you sef na baba for dis laguajeo. In fact sef, my hand don dey shake as I dey rite dis becos I don see say mi sef, I never learn to rite the Pijjin as you dey rite am.
You don even tell us about dot under and dot on top. Na wao! You go teach us?
My broda, welkom! Abeg you go give us information about the Bible wen una dey rite. The only Bible wen I don see for Pijjin na the book of John. We get "Our Father" for dis forum.
You know wetin? Small time eh, we go open one board for dis forum especially for you and all the wise wise tins wen you fit tell us.
You project get internet site? A beg where e dey.
Meanwhile, welkom. Na house you don reach. Make you stay and even self, bring all your people dem.
Dat buk wen you talk (MEK WI SPIIK NAIJIRIA PIJIN)... you fit pubish some parts for here small small?
Ma Brọda Baba,
Ma bẹlẹ swiit mi gọọn wẹn a rid di riplai wee yu rait abaut di smọl tins wee a rait abaut masẹf an ma wọk. No wahala.
Bifọ a stat to de tọk ọda tins, a want mek yu sii see a dọn de put di dọt-dẹm fọ ọnda “o” an ọnda “e” fọ wia dẹm sọpoz dee. Wẹn a taip dis lẹta finish fọ Maikrosọft Wọd, a go kọpi am an kari am go fọ yọ forum. An dẹn a go pest am dia. Na dis wee go fit mek di dọt-dẹm to sho.
Nau, mek a tek sọfli sọfli tek ansa sọm ọf di kwẹshọn-dẹm wee yu aks.
Yọ Naijiria Pijin Lanwej (NPL)
Yọ Naijiria Pijin dee kọrẹkt an i dee fain. Di onli wahala na di wee wee yu de spẹl sọm ọf di wọd-dẹm.
Baba, mek a tẹl yu sọmtins wee dee impọtant wẹl wẹl. If wi fọlo am, na im bi see wi go put NPL fọ di bẹta ples wee i sọpoz dee an di lanwej go gẹt di rẹspẹkt wee bi im oon. Dis na di tins:
Nọmba 1: Mek wi stọp to de kọl am Naijiria Pijin Inglish. Di lanwej na Naijiria Pijin Lanwej (NPL) ọọ Naijiria Pijin (NP).
NPL ọọ NP na lanwej wee gẹt im oon ee-bii-sii-di. I gẹt im oon wee fọ tek spẹl an rait im wọd-dẹm. Ẹspat-dẹm sidọn togẹda fọ Yunivasiti ọf Ibadan an disaid am so fọ 2003.
Di wee fọ tek spẹl an rait NPL wọd-dẹm na im Oyibo de kọl “NPL Orthography” (NPL Ọtọgrafi).
Ẹvri lanwej fọ wọld gẹt im oon wee fọ tek spẹl an rait im wọd-dẹm. Inglish gẹt im oon, Jaman gẹt im oon, Japan gẹt im oon tuu. Na so i dee fọ Yoruba, Igbo, Hausa, Ishẹkiri an ọda lanwej-dẹm. Sodiafọ, NPL gẹt im oon wee fọ tek spẹl an rait im wọd-dẹm.
Na bad tin fọ pẹsin to yuz Inglish spẹlin tek de spẹl NPL wọd-dẹm. If wi de du am so, i min see fọ pẹsin to lẹn hau to rait an rid NPL, im mọst to fẹst go lẹn hau to rid an rait Inglish Lanwej fain fain. Dat wọn na dọbul wahala.
Sodiafọ if wi mọst to du tins fọ kọrẹkt wee, wi gẹt to stat bai to tich pipul NPL ee-bii-sii-di. Dẹn wi fit waka ẹnta hau to rait NPL and hau to rid am. Dat awa buk wee wi de kọl “Mek Wi Rid Naijiria Pijin” go handul di mata fain fain.
Nọmba2: Intanẹt Sait:
Wi nẹva gẹt intanẹt Sait fọ awa wọk. Bọt wi trọst see Gọd go hẹlp ọs an i nọ go tee wi go bild wọn fọ awa wọk.
Nọmba 3: Mek Wi Rid Naijiria Pijin
Abẹg mek yu no vẹks. Di buk na Mek Wi Rid Naijiria Pijin nọ bi Mek Wi Spiik Naijiria Pijin. Na ma mistek. Mek yu no vẹks ma brọda.
Abaut di mata ọf to put pat ọf di “Mek Wi Rid Naijiria Pijin” fọ di forum, a go diskọs am wit ma pipul an wi go sii hau wi go du am. Bọt i nọ go tee, wi go print di buk-dẹm (Buk 1 an Buk 2).
Nọmba 4: Hawaii Pijin
Awa Lọd Im Preya wee a sii fọ di forum na fọ Hawaii Pijin. Dat pijin nọ bi sem wit awa pijin. Di pijin wee dee nia awa oon na Kamroon Pijin bọt i stii dee difrẹn frọm awa oon.
Mek yu no wọri Baba. Na smọl smọl dẹm de tek lik họt sup. Wi go de put awa wọk fọ yọ forum an go du plẹnti ọda tins wee kọnsan pijin wit una. Jọni dọn stat-oo an na wọn wọn stẹp wi go de tek de waka am de go.
Nẹst taim, a go stat to de tọk abaut di Baibul wọk wee wi de du.
Mek a stọp hia.
Mek Gọd blẹs yu an giv yu ẹvritin wee yu niid an mek Im giv am to yu nyafu nyafu.
Ehee! Bifọ a fọgẹt, a bi Ol Bọi. A nọ bi Ol Gẹl. Bọt ma yiẹs dọn pas 50 yiẹ. Abi yu go kọl mi Ol Man?
Dumama
Dumama, tank yu fo ya mesej. Everytin wee yu rite mek ma belle sweet wel wel. Tank yu oso fo all di koresion we yu do. I karry all of dem. I no go col am Naijiria Inglish agen.
I agree wit yu about the dot dem, but dat one go hard small o, she you know?! Becos e go be like double work fo people dem, becos say di keyboard wee we dey use no bi for Pijjin. Anyhow, make we see as e go bi.
I agree with everytin wey yu talk and even sef, I happi well well say yu come here. U know why? Becos wen we tink of dis forum, na becos we realize say we get sometin unik for our lainwej and as Wazobia radio don show, our pipple dem like dia own lainwej no be small.
E even be lik say yu go skool for Pijjin.
Small time, I go make yu Administrator for dis site so that you go decide topics and even become principal fo pijjin skool.
My broda, e go be. God bless you 2!
My brother-dem, this una conversation sweet my belle well well.
I have been so interested in finding reading materials in Pijjin. For many years, I have searched all over the internet to no avail.
We need story books in pijjin, novels in pijjin, magazines in pijjin....It baffles me that such do not exist.
I really need to lay my hands on that Pijjin Bible translation.
Thank you for all the work you are doing.
Nick
NickOke1, welkom! You don reach house

Baba, thank you O! I feel you well well.
Long live Pijjin!
Dis title 'baba'... I don see very many baba inside all dat time wey I dey for 9ja. But broda mi, I fit say that you deserve am well well. Nick, radio station dey sharh

Make you publish book for Canada so I go fit read am.
I no fit say e don sweet my belle, juss because I don chop very salty oyibo food. Me I dey promote dis betta place o!
Since their creation in 1984,
Air Jordan Women have been among the best-selling basketball shoes in the world. The hype surrounding Jordan shoes can be attributed to their inspiration and their namesake: Michael Jordan. From the Air Jordan I ?which turned the basketball shoe industry upside-down in 1984 ?to the era of Tinker Hatfield and his revolutionary Jordan designs like the Air Jordan III, Air Jordan V and the Air Jordan XIII, to the recent hits like the Air Jordan 2011 and the Flight series, Jordan shoes have proven to be unstoppable.
Welcome visiting
Air Jordan 2011 Black Shoes ,Air Jordan Shoes we commit to provide for you in best quality in absolutely cheap price!Air Jordan numbered series now all deserve to be a collection,excellent soft and advance technology apply,Nike Air Jordan we supply in reliable standard in super sale off!Every edition of Air Jordan Shoes combine times most advance element,make you outstanding,buy cheap Air Jordan shoes here,24 hours online,free shipping,non sales tax,best customer service we provide.Now first-classy
Air Jordan Spizikes ,Retro Air Jordan 1 to
Air Jordan All Day Perfect White ,Air Jordan Fusion series etc Cheap Jordan Shoes ideal choice huge discount supply here,hurry up to have one,there is no time to delay!---By Nike Shoes Air Jordan at airjordanshoes2.com
Air Jordan Fusion 4 Black Green
But Reyes reiterated what he has stated all along: He does not need to negotiate through the season.gerard pique jersey That stance has not transformed since, in accordance with
2011-2012 club soccer jersey, one of Reyes's agents.It's feasible the injury could support the Mets re-sign Reyes. If other clubs look at him as injury-prone, it may maybe reduce the odds of an extra club out-bidding the Mets, whose financial wherewithal is in doubt. however it is as well earlier to understand just how as well as once the injury will effect his certainly free agency.If practically nothing else, the injury figures to cut back Reyes's make trades value, which tends to allow it to be even much less in all likelihood which they would make trades him earlier to
2011-2012 National soccer jersey. But unless the Mets can locate a method to preserve successful without the need of him, several of his teammates may maybe be gone from the time he returns.Mets common manager Sandy Alderson stated Wednesday the fact that subsequent 10 to twelve movement photo games can be pivotal as he decides
Barcelona soccer jersey to not preserve the team collectively for that extention run or make trades with an eyesight toward the future.